Well dis one happen for inside our hostel gan gan! Girls hostel o. I know say dis one na the first official tori wey dey come from our hostel. But my people u no go believe wetyn I see with my two eyes!!
One 400L guy wey we dey call **uhm uhm I no talk o b4 em use em big big muscle dem finish me. Hahahah! Ok back to the matter, em babe been dey celebrate birthday about three days from today, naso my guy as a bigger boy wey we dey see am as waka go Famous Uncle Shoprite go shop for em babe, I hear say na she be Miss World for her department, Chai chineke!!!
Well leave mata say na even Uncle Shoprite em go, guess wetyn em con buy? Ogirl na rubber slippers with shower cap and that N400 body spray, emmm wetyn dem dey call the spray again sef, dat one wey dey stain cloth na. Naso em package all this goods give our Miss World o.
Naso she vex con carry the slippers with shower cap give girls make dem rock am con carry the body spray do 'Raid' for hostel! Chai na here I con pity for the boy o, nawa for the Miss World o! She for collect am con secretly dispose am na. But I hear say she con dey tell everybody o infact anybody wey care to listen! Chai chineke!!!
Wait o e never end for der o, I con later hear say d boy con go buy palm wine put am for 'Ragolise' bottles con give our Miss World make she high herself and her friends. hahahahah! Chai d worst tori b say she con breakup with the bobo after their long relationship wey last for 2 whole months. Hehe Chai chineke!!!
Abeg I hear say e get one 'EYE' wey dey disturb us for dis our small website, abeg if you know say u get mind show urself na do wetyn u sabi do make we knw ur worth. Mtcheeeeew nonsense!
For Birthday Shoutouts, BestFriends Shoutout, Announcements, Breaking News, Flash news, CSO news, Gossips, Music release, Articles and Anything worth our audience views at the Olofofo please forward all Articles and publications to
Welsuolofofo@gmail.com
Comments